Kwata Style Medicine

Kwata Style Medicine "Kwata Style Medicine" 🩺🇚🇲
Aims at Sensitizing The Community About Health Through Pidgin-English

𝙊𝙣 𝙩𝙝𝙞𝙚 𝙚𝙥𝙞𝙚𝙀𝙙𝙚 71 𝙂𝘌𝙎𝙏𝙍𝙄𝙏𝙄𝙎 ( 𝙬𝙀𝙪𝙣𝙙 𝙛𝙀𝙧 𝙗𝙚𝙡𝙡𝙚) 𝙡𝙞𝙠𝙚&𝙛𝙀𝙡𝙡𝙀𝙬 Kwata Style Medicine  🇚🇲 👚🏜 𝐎𝐆𝐀 𝐌𝐑 𝐒𝐌𝐀𝐑𝐓 :Good morning Docto...
24/05/2026

𝙊𝙣 𝙩𝙝𝙞𝙚 𝙚𝙥𝙞𝙚𝙀𝙙𝙚 71 𝙂𝘌𝙎𝙏𝙍𝙄𝙏𝙄𝙎 ( 𝙬𝙀𝙪𝙣𝙙 𝙛𝙀𝙧 𝙗𝙚𝙡𝙡𝙚) 𝙡𝙞𝙠𝙚&𝙛𝙀𝙡𝙡𝙀𝙬 Kwata Style Medicine 🇚🇲
👚🏜 𝐎𝐆𝐀 𝐌𝐑 𝐒𝐌𝐀𝐑𝐓 :
Good morning Doctor

👚🏜‍⚕𝙆𝑟𝑚𝑻𝑚 𝑫𝑶𝑪𝑻𝑶𝑹:
Good mornx Oga mr smart and Mrs Smart.
Na how wunna sleep?

👚🏜 𝐎𝐆𝐀 𝐌𝐑 𝐒𝐌𝐀𝐑𝐓 :
Are no sleep fine doc. Since some days now my belle dey hot, e dey pain me for upper side. Sometimes I dey feel like vomit and chop no dey sweet me again.

👩🏜 𝗠𝗥𝗊 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧:
Doctor, even for night e no dey sleep well. If e chop pepper or drink beer, na so the pain go start again.

👚🏜‍⚕𝙆𝑟𝑚𝑻𝑚 𝑫𝑶𝑪𝑻𝑶𝑹:
Hmm Oga Smart, wetin you get fit be GASTRITIS. Make I explain-am small-small.

*Wetin be Gastritis?
Gastritis na when the inside wall of the stomach get irritation, swelling or small-small wound.
Na why person go dey feel burning pain or discomfort for belle.
Some people dey call-am:
- Belle wound
- Hot stomach
-Acid for belle

*Signs and Symptoms of Gastritis
Person wey get gastritis fit get:
-Burning pain for upper belle
-Belly hot like fire
-Nausea and vomiting
-Loss of appetite
-Feeling full quick after small food
-Too much belching (frog for mouth)
-Bloating and gas
-Chest burning (heartburn)
-Weakness sometimes
Black stool if bleeding dey inside
❌ Causes of Gastritis

👚🏜 𝐎𝐆𝐀 𝐌𝐑 𝐒𝐌𝐀𝐑𝐓 :
Doctor, wetin dey really cause-am?

👚🏜‍⚕𝙆𝑟𝑚𝑻𝑚 𝑫𝑶𝑪𝑻𝑶𝑹:
Many things fit cause gastritis:
🍺 1. Too much alcohol
Beer and strong drink fit damage stomach wall.
🌶 2. Too much pepper and rough food
Especially if person no chop on time.
💊 3. Too much drugs
Like:
Diclofenac
Ibuprofen
Aspirin
If person take-am anyhow without food.
🊠 4. Helicobacter pylori infection (H. pylori)
Na bacteria wey dey live for stomach.
😰 5. Stress and worry
Too much thinking fit increase acid.
🚬 6. Smoking
Cigarette fit worsen stomach irritation.
🍜 7. Staying hungry for long
Skipping meals every day no good.
🧪 Laboratory Tests for Gastritis

👩🏜 𝗠𝗥𝗊 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧:
Doctor, which test dem fit do?

👚🏜‍⚕𝙆𝑟𝑚𝑻𝑚 𝑫𝑶𝑪𝑻𝑶𝑹:
For confirm gastritis, hospital fit do:
🧫 1. H. pylori Test( this test so de di do am for check the bacteria wah di cause gastric)
Stool antigen test
Blood test
Breath test
🔬 2. Endoscopy
Doctor pass small camera look inside stomach.
🩞 3. Full Blood Count (FBC)
To check if person don lose blood.
💩 4. Stool occult blood test
To check hidden blood for stool.
💊 Treatment of Gastritis

👚🏜‍⚕𝙆𝑟𝑚𝑻𝑚 𝑫𝑶𝑪𝑻𝑶𝑹:
Treatment go depend on wetin cause the problem.
Common medicines:
💊 Antacids
Reduce stomach acid
💊 Omeprazole / Pantoprazole
Help stomach heal
💊 Antibiotics
If na H. pylori infection cause-am.
💊 Anti-vomiting medicine
If person dey vomit too much.
⚠ No take medicine without doctor or nurse advice.
🏡 How To Manage and Prevent Gastritis
- Chop on time always
-Reduce pepper and spicy food
-Avoid too much alcohol
-Stop smoking
-Drink enough water
-Avoid taking drugs anyhow
-Reduce stress and overthinking
-Eat fruits and balanced food
-Go hospital early if pain continue
🚚 Danger Signs – Run Go Hospital Fast
🚑 If person get:
-Vomiting blood
-Black stool
-Severe belly pain
-Fainting
-Weight loss
-Serious weakness

👚🏜‍⚕𝙆𝑟𝑚𝑻𝑚 𝑫𝑶𝑪𝑻𝑶𝑹: :Final Advice from
“OGA and MRS SMARTS, gastritis no be small thing if person ignore-am. Early treatment and good feeding fit help stomach heal quick. No dey self-medicate always.”

👚🏜 𝐎𝐆𝐀 𝐌𝐑 𝐒𝐌𝐀𝐑𝐓 :
Thank you doctor, today I don understand my problem well-well.

👩🏜 𝗠𝗥𝗊 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧 :
We go follow all your advice doctor.

👚🏜‍⚕𝙆𝑟𝑚𝑻𝑚 𝑫𝑶𝑪𝑻𝑶𝑹: :
Wunna welcome and wunna know say wunna health nawa priority nor so wunna stay bless

Writer :SIMON (BSC)

𝙊𝙣 𝙩𝙝𝙞𝙚 𝙚𝙥𝙞𝙚𝙀𝙙𝙚 72 (𝙃𝘌𝙉𝙏𝘌𝙑𝙄𝙍𝙐𝙎) 𝙡𝙞𝙠𝙚 & 𝙛𝙀𝙡𝙡𝙀𝙬 Kwata Style Medicine  🇚🇲 (read) 👇👇 👩🏜 𝑎𝑹𝑺 𝑺𝑎𝑚𝑹𝑻: Good Afternoon doctor. 👚🏜...
17/05/2026

𝙊𝙣 𝙩𝙝𝙞𝙚 𝙚𝙥𝙞𝙚𝙀𝙙𝙚 72 (𝙃𝘌𝙉𝙏𝘌𝙑𝙄𝙍𝙐𝙎) 𝙡𝙞𝙠𝙚 & 𝙛𝙀𝙡𝙡𝙀𝙬 Kwata Style Medicine 🇚🇲 (read) 👇👇
👩🏜 𝑎𝑹𝑺 𝑺𝑎𝑚𝑹𝑻:
Good Afternoon doctor.

👚🏜‍⚕ 𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥:
Afternoon MRS SMART.
Na how for you eeh?

👩🏜 𝑎𝑹𝑺 𝑺𝑎𝑚𝑹𝑻:
Adeh ooh doctor. I hear people di talk one sickness dem call am Hantavirus. Wetin be that so?

👚🏜‍⚕ 𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥:
Ok u too u don hear that news way ei di talk about that sickness call Hantavirus.

Hantavirus na dangerous virus wey fit affect human being. E mostly di come from rat and other bush rodents. Person fit sick serious especially for lungs and kidney if e no get treatment quick.

*WETIN BE HANTAVIRUS?

👚🏜‍⚕ 𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥:
Hantavirus na virus wey rat and bush mouse di carry. The virus dey for their urine, s**t (faeces) and saliva.
When person breathe dirty dust wey get the virus, e fit enter body and cause serious sickness.
Some people fit get:
-Serious breathing problem
-Fever
-Kidney wahala
-Body weakness

*HOW E DI SPREAD?

👩🏜 𝑎𝑹𝑺 𝑺𝑎𝑚𝑹𝑻:
Doctor, how person fit catch this sickness?

👚🏜‍⚕ 𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥:
Mama Smart, person fit get Hantavirus through:
-Breathing dust from rat urine or s**t
-Sweeping dirty room or store wey rat don stay
-Eating food contaminated by rats
-Touching rat urine or saliva then touch mouth or nose
-Rarely through rat bite
-Dirty environment and plenty rats for house increase risk.

*SIGN AND SYMPTOMS

👩🏜 𝑎𝑹𝑺 𝑺𝑎𝑚𝑹𝑻:
How person go know say na this sickness?

👚🏜‍⚕ 𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥:
The sickness fit start like ordinary fever but later become dangerous.

*Early signs:
-Fever
-Headache
-Body pain
-Tiredness
-Chills
-Vomiting
-Belly pain

*Serious signs:
-Difficulty breathing
-Chest pain
-Dry cough
-Fast heartbeat
-Kidney problem
-Low urine
-Severe weakness
-If person no breathe well, rush am go hospital immediately.

*HOW DOCTOR DI DIAGNOSE AM?

👩🏜 𝑎𝑹𝑺 𝑺𝑎𝑚𝑹𝑻:
Which test dem di do?

👚🏜‍⚕ 𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥:
Doctor fit do:
🔬 Blood test for Hantavirus antibodies
🩞 Full blood count (FBC)
🫁 Chest X-ray for lung problem
🧪 Kidney function test
🌡 Vital signs monitoring
Doctor go also ask if rats plenty around the patient house or work area.

*TREATMENT
👩🏜 𝑎𝑹𝑺 𝑺𝑎𝑚𝑹𝑻:
Doctor wetin be the treatment?

👚🏜‍⚕ 𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥:
No special cure dey completely for Hantavirus, but quick treatment for hospital fit save life.
Treatment include:
-Oxygen for breathing
-IV fluids carefully
-Drugs for fever and pain
-Intensive care if sickness serious
-Kidney support or dialysis if kidney fail
-No self-medication.
-Go hospital quickly if symptoms strong.

*MANAGEMENT
👚🏜‍⚕ 𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥:
To manage patient well:
-Plenty rest
-Good monitoring for breathing
-Keep patient hydrated
-Maintain clean environment
-Follow doctor instructions
-Avoid exposure to rats again

*PREVENTION
👩🏜 𝑎𝑹𝑺 𝑺𝑎𝑚𝑹𝑻:
How we fit prevent am?

👚🏜‍⚕ 𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥:
-Keep house clean always
-Cover food well
-Kill and control rats around house
-Close rat holes for house
-Wear mask when cleaning dirty stores
-Avoid touching rat urine or s**t with bare hand
-Wash hands regularly
-Dispose garbage properly

👚🏜‍⚕ 𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥:FINAL ADVICE
My people, no take rat infestation play.
Clean environment fit save life.
If fever plus breathing problem start after contact with rats, go hospital fast-fast.

👩🏜 𝑎𝑹𝑺 𝑺𝑎𝑚𝑹𝑻:
Thank you Kwata Doctor 😊
Today we don learn say cleanliness and early hospital treatment important well-well.

👚🏜‍⚕ 𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥:
You always dey wlc and stay bless ok🥰❀🥰

“Health Na Wealth” 💚

WRITER: SIMON (BSC)

𝗢𝗻 𝘁𝗵𝗶𝘀 𝗲𝗜𝗶𝘀𝗌𝗱𝗲 𝟳𝟬 (𝗧𝗬𝗣𝗛𝗢𝗜𝗗 𝗙𝗘𝗩𝗘𝗥) 𝗹𝗶𝗞𝗲 & 𝗳𝗌𝗹𝗹𝗌𝘄 Kwata Style Medicine  🇚🇲 (read) 👇  👎🏿 𝗢𝗚𝗔  𝗠𝗥 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧  :Doc good morning....
13/05/2026

𝗢𝗻 𝘁𝗵𝗶𝘀 𝗲𝗜𝗶𝘀𝗌𝗱𝗲 𝟳𝟬 (𝗧𝗬𝗣𝗛𝗢𝗜𝗗 𝗙𝗘𝗩𝗘𝗥) 𝗹𝗶𝗞𝗲 & 𝗳𝗌𝗹𝗹𝗌𝘄 Kwata Style Medicine 🇚🇲 (read) 👇
👎🏿 𝗢𝗚𝗔 𝗠𝗥 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧 :
Doc good morning.

👚🏜‍⚕𝑲𝑟𝑚𝑻𝑚 𝑫𝑶𝑪𝑻𝑶𝑹 :
Morning papa how for you eeh?

👎🏿 𝗢𝗚𝗔 𝗠𝗥 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧 :
Doctor are no dey fine, my body hot, belle di pain me, I weak well well and I no get appetite, s**t too no dey comote. Wetin di worry me?

👚🏜‍⚕𝑲𝑟𝑚𝑻𝑚 𝑫𝑶𝑪𝑻𝑶𝑹 :
Ooh ashai Oga
Mr Smart, e fit be *Typhoid Fever* . Na sickness wey bacteria call *Salmonella typhi* di cause. Dirty water and dirty food mostly di spread am.

👎🏿 𝗢𝗚𝗔 𝗠𝗥 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧 :
Doctor, how person di catch typhoid?

👚🏜‍⚕𝑲𝑟𝑚𝑻𝑚 𝑫𝑶𝑪𝑻𝑶𝑹 :
-Drink dirty water
-Chop dirty food
-No wash hand after toilet
-Flies touch food
-Poor sanitation area

👎🏿 𝗢𝗚𝗔 𝗠𝗥 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧 :
Doctor, how person go know say na typhoid?

👚🏜‍⚕𝑲𝑟𝑚𝑻𝑚 𝑫𝑶𝑪𝑻𝑶𝑹 :

*Signs and Symptoms* :

- High fever
- Headache
- Body weakness
- Belle pain
- Running stomach or hard stool
- Vomiting sometimes
- Loss of appetite
- Body pain
- Tiredness

👎🏿 𝗢𝗚𝗔 𝗠𝗥 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧 :
Doctor, e get danger?

👚🏜‍⚕𝑲𝑟𝑚𝑻𝑚 𝑫𝑶𝑪𝑻𝑶𝑹 :
Yes oo, if e no treat quick:

- Severe dehydration
- Intestine fit tear
- Serious infection
- Confusion
- Death for bad case

👎🏿 𝗢𝗚𝗔 𝗠𝗥 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧 :
Doctor, how una di test am?

👚🏜‍⚕𝑲𝑟𝑚𝑻𝑚 𝑫𝑶𝑪𝑻𝑶𝑹 :

-Blood test
-Stool test
-Widal test (but no always accurate)
-Culture test na better one

👎🏿 𝗢𝗚𝗔 𝗠𝗥 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧 :
Treatment nko?

👚🏜‍⚕𝑲𝑟𝑚𝑻𝑚 𝑫𝑶𝑪𝑻𝑶𝑹 :

-Correct antibiotics dey wah are go write am for you ok
-Plenty clean water / ORS
-Rest well
-Fever medicine go dey wah are go write for u for that high temperature ok
-- Chop light food and well cooked food ok

👎🏿 𝗢𝗚𝗔 𝗠𝗥 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧 :
Wetin person fit do for prevent am?

👚🏜‍⚕𝑲𝑟𝑚𝑻𝑚 𝑫𝑶𝑪𝑻𝑶𝑹 :

- Wash hand with soap
- Drink clean boiled water
- Chop clean hot food
- Cover food
- Use clean toilet
- Keep environment clean
- Typhoid vaccine fit help

👚🏜‍⚕𝑲𝑟𝑚𝑻𝑚 𝑫𝑶𝑪𝑻𝑶𝑹 Final Advice: stop for di buy cooked food for road side and also make sure sah u filter ya water well or boil before you dey drink am ok.

Your health nawa priority ok🙏❀🙏
Writer : SIMON (Bsc)

𝗢𝗻 𝗧𝗵𝗶𝘀 𝗘𝗜𝗶𝘀𝗌𝗱𝗲 𝟲𝟵"*𝗖𝗢𝗡𝗝𝗚𝗡𝗖𝗧𝗜𝗩𝗜𝗧𝗜𝗊 (𝗔𝗜𝗌𝗹𝗹𝗌)* "𝗹𝗶𝗞𝗲 & 𝗳𝗌𝗹𝗹𝗌𝘄 🇚🇲 Kwata Style Medicine 🇚🇲 (read)👇 👇 👇👚🏜‍🊱𝑶𝒈𝒂 𝑎𝒓. 𝑺𝒎𝒂𝒓𝒕: goo...
28/04/2026

𝗢𝗻 𝗧𝗵𝗶𝘀 𝗘𝗜𝗶𝘀𝗌𝗱𝗲 𝟲𝟵"*𝗖𝗢𝗡𝗝𝗚𝗡𝗖𝗧𝗜𝗩𝗜𝗧𝗜𝗊 (𝗔𝗜𝗌𝗹𝗹𝗌)* "𝗹𝗶𝗞𝗲 & 𝗳𝗌𝗹𝗹𝗌𝘄 🇚🇲 Kwata Style Medicine 🇚🇲 (read)👇 👇 👇
👚🏜‍🊱𝑶𝒈𝒂 𝑎𝒓. 𝑺𝒎𝒂𝒓𝒕: good morning Doctor

👩🏜‍⚕𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥: Good mornx. How for you and how all man sleep for house?

👚🏜‍🊱𝑶𝒈𝒂 𝑎𝒓. 𝑺𝒎𝒂𝒓𝒕: we sleep fine doctor and family dey fine

👩🏜‍⚕𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥: So na wati bring wunna for hospital?

👚🏜‍🊱𝑶𝒈𝒂 𝑎𝒓. 𝑺𝒎𝒂𝒓𝒕:Doctor, my pikin eye don red, e swell small, e dey bring yellow dirt and e dey complain say e dey pain am then ei dey also give yi fever too. Wetin really dey happen?

👩🏜‍⚕𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥 :
Mr Smart, wetin your pikin get na Conjunctivitis(Apollo) . Na sickness wey dey affect the front cover of the eye ( conjunctiva). And ashai ok no over worry your pekin go dey fine ok

- **Pathology* *(How e take* *happen):**
When germ (virus or bacteria), dust or allergy enter eye, e go cause inflammation. That one go make blood vessels show, na why eye go turn red, swell and begin produce water or pus.

👚🏜‍🊱𝑶𝒈𝒂 𝑎𝒓. 𝑺𝒎𝒂𝒓𝒕: :
Doctor, how e take catch am?

👩🏜‍⚕𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥 :
- *Transmission* ( *How e* *dey spread)** :
Touch infected eye then touch another person
Sharing towel, pillow, handkerchief
Dirty hand wey touch eye
Cough or sneeze (for viral own)
Dust and dirty environment
- Na why e dey spread fast fast for school children dem.

👚🏜‍🊱𝑶𝒈𝒂 𝑎𝒓. 𝑺𝒎𝒂𝒓𝒕 :
Which sign wey we suppose notice?

👩🏜‍⚕𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥:
* *Signs & Symptoms** :
Eye go red well well
Water or yellow/green dirt go dey come out
Eye go itch or pain
Pikin go dey rub eye always
Eye fit glue for morning
Light fit dey disturb the eye
Sometimes one eye start, e go enter the other one

👚🏜‍🊱𝑶𝒈𝒂 𝑎𝒓. 𝑺𝒎𝒂𝒓𝒕:
Okay doctor, how we go treat am?

👩🏜‍⚕𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥 :
*Treatment* :ok i go explain am for u in step by step how the go fit treat am ok Because some of this condition na bacteria dey cause am and also some na virus ok. So make are explain am for you ok
*For bacteria* : Are go give antibiotic eye drops or ointment
*For virus* : e go clear by itself, but we give supportive care
For allergy: anti-allergy eye drops
Clean eye with clean water or saline

👚🏜‍🊱𝑶𝒈𝒂 𝑎𝒓. 𝑺𝒎𝒂𝒓𝒕:
How we fit know say na bacteria or virus Apollo Doctor ?

👩🏜‍⚕𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥:ok for know if na bacteria Apollo we go do some lab tests some bacteria dey wah dem di called am for big book say *Staphylococus* so when dis bacteria enter your eyes ei go start bring itches, yellow thick discharge n yah eyes them go start look red.
Then for u for know say na virus Apollo we go also do lap test as we do for the first one then we go see another virus wah them di called am for big book say *adenovirus* this one go make your eyes look watery n glassy so na ei that so Papa

👚🏜‍🊱𝑶𝒈𝒂 𝑎𝒓. 𝑺𝒎𝒂𝒓𝒕: ok thank you doctor. So na how we fit manage am and care too?

👩🏜‍⚕𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥:
* *Management & Care** :
-Wash pikin e hand always
-Clean eye gently (from inside go outside)
-Use clean cloth each time
-No allow sharing of towel or pillow
- Keep pikin away from dust
-Make e rest well

👚🏜‍🊱𝑶𝒈𝒂 𝑎𝒓. 𝑺𝒎𝒂𝒓𝒕:
Some people dey put breast milk or leaf for eye, e good?
and na so my woman tell me doc

👩🏜‍⚕𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥 :
❌ No try am! E fit add more infection and make eye worse

👩🏜‍⚕𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥: *( *Final Advice)* :
-Make ei no dey touch touch the eyes like ei go dey swell and red again bad and ei go worsen the case ok
- Make pikin stay house small to avoid spreading am for other children.
-Protect your pikin dem 👶🏜❀ Health na wealth!

𝗢𝗻 𝗧𝗵𝗶𝘀 𝗘𝗜𝗶𝘀𝗌𝗱𝗲 𝟲𝟎" 𝗛𝗢𝗡𝗘𝗬𝗠𝗢𝗢𝗡 𝗖𝗬𝗊𝗧𝗜𝗧𝗜𝗊) "  𝗟𝗶𝗞𝗲 & 𝗙𝗌𝗹𝗹𝗌𝘄 Kwata Style Medicine    🇚🇲⬇⬇⬇💏𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿/𝗠𝗿𝘀 𝗊𝗺𝗮𝗿𝘁: Good morning...
05/05/2024

𝗢𝗻 𝗧𝗵𝗶𝘀 𝗘𝗜𝗶𝘀𝗌𝗱𝗲 𝟲𝟎" 𝗛𝗢𝗡𝗘𝗬𝗠𝗢𝗢𝗡 𝗖𝗬𝗊𝗧𝗜𝗧𝗜𝗊) " 𝗟𝗶𝗞𝗲 & 𝗙𝗌𝗹𝗹𝗌𝘄 Kwata Style Medicine 🇚🇲⬇⬇⬇
💏𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿/𝗠𝗿𝘀 𝗊𝗺𝗮𝗿𝘁: Good morning doctor.

👩🏟‍⚕𝑲𝙒𝑚𝙏𝑚 𝑫𝙊𝑪𝙏𝑶𝙍 : Good morning. How for wuna?

💏𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿/𝗠𝗿𝘀 𝗊𝗺𝗮𝗿𝘁: We dey fine small doctor.

👩🏟‍⚕𝑲𝙒𝑚𝙏𝑚 𝑫𝙊𝑪𝙏𝑶𝙍 : okay, so weti be the problem?

👚🏿𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿. 𝗊𝗺𝗮𝗿𝘁: Doctor, me and ma woman marret last week, we come Kribi for go chop small life for our honeymoon then some badluck thing so no go leavam make man enjoy body and small knacking.

👩🏟‍⚕𝑲𝙒𝑚𝙏𝑚 𝑫𝙊𝑪𝙏𝑶𝙍 : na weti be that badluck thing eh?

👩🏟𝑶𝒈𝒂 𝑎𝒓𝒔 𝑺𝒎𝒂𝒓𝒕:A di over p**s doctor and when the p**s di comot, e di over hurt me. I noticam about 2 days after we reach Kribi.

👚🏿𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿. 𝗊𝗺𝗮𝗿𝘁: Massa doctor, the thing di over disturb this our small enjoyment time. Anytime weh we just meet so for do small bad fashion ,madam go start complain say e want go p**s eh and e fit waste time, e di even start comot for e skin. Na why that I say make we come so that you fit checkam helep we. Make something no spoil this our beautiful moment abeg.and worse thing na say we be Don first do check up all thing be dey fine. So this one comot for wusite now?

👩🏟‍⚕𝑲𝙒𝑚𝙏𝑚 𝑫𝙊𝑪𝙏𝑶𝙍 : Okay okay. Wuna ashia and congratulations for the wedding. Well the problem na small one weh no fit spoil wuna enjoyment moment. So ya madam get weti we di callam for big book say 𝗛𝗢𝗡𝗘𝗬𝗠𝗢𝗢𝗡 𝗖𝗬𝗊𝗧𝗜𝗧𝗜𝗊 (urinary bladder infection and pain way he Di be caused by s°ex) bladder na some part way he Di store p**s.

🎆This sick na simply infection we di affect woman e side for p**s as a result of sexual in*******se. So as wona dey for honeymoon, I di assume say, knacking na back to back. Na why that madam don get this small infection.

🎆During the process for sexual in*******se, your man skin di carry bacteria from outside go put for inside weh p**s di comot for woman then now e di enter the bladder cause the infection weh di give her those symptoms way he Di p**s all time or he Di feel pain while she Di p**s .

👚🏿𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿. 𝗊𝗺𝗮𝗿𝘁: So eh doctor, so now so, weti man fit do nor, for cure the infection?

👩🏟‍⚕𝑲𝙒𝑚𝙏𝑚 𝑫𝙊𝑪𝙏𝑶𝙍 : I go write some mesin weh she go takam and e go finish.

👚🏿𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿. 𝗊𝗺𝗮𝗿𝘁: Thank you doctor. Hope say the mesin no go affect our enjoyment??

👩🏟‍⚕𝑲𝙒𝑚𝙏𝑚 𝑫𝙊𝑪𝙏𝑶𝙍 : No, e no go affect anything

👚🏿𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿. 𝗊𝗺𝗮𝗿𝘁: Thank God.

👩🏟𝑶𝒈𝒂 𝑎𝒓𝒔 𝑺𝒎𝒂𝒓𝒕:: Abeg doctor, why e bi say na only woman di get this kind sick and weti a fit do for avaoidam?

👩🏟‍⚕𝑲𝙒𝑚𝙏𝑚 𝑫𝙊𝑪𝙏𝑶𝙍 : Well woman e side for p**s over short and e just dey corner e woman part na why that bacteria fit easily comot from there enter the side for p**s.

💞We di advice woman say, immediately after e meetup with man, e di fine make she go p**s, so that e fit p**s out any bacteria weh don be introduce during the process.

💞Na for the same reason weh we di advice woman when e p**s or s**t for clean herself from front to back and not the reverse.

💏𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿/𝗠𝗿𝘀 𝗊𝗺𝗮𝗿𝘁: Thank you very much doctor
👩🏟‍⚕𝑲𝙒𝑚𝙏𝑚 𝑫𝙊𝑪𝙏𝑶𝙍: You are welcome. Wuna enjoy fine.

Writer : DOCTOR Tete Yvonne Holistic MD

𝗢𝗻 𝗧𝗵𝗶𝘀 𝗘𝗜𝗶𝘀𝗌𝗱𝗲 𝟲𝟳" 𝗕𝗟𝗜𝗚𝗛𝗧𝗘𝗗 𝗢𝗩𝗚𝗠 (𝗘𝗠𝗣𝗧𝗬 𝗣𝗥𝗘𝗚𝗡𝗔𝗡𝗖𝗬) "  𝗟𝗶𝗞𝗲 & 𝗙𝗌𝗹𝗹𝗌𝘄 Kwata Style Medicine   🇚🇲⬇⬇⬇🀰🏜👥𝑶𝒈𝒂 𝑎𝒓/𝑎𝒓𝒔 𝑺𝒎𝒂𝒓𝒕:...
14/04/2024

𝗢𝗻 𝗧𝗵𝗶𝘀 𝗘𝗜𝗶𝘀𝗌𝗱𝗲 𝟲𝟳" 𝗕𝗟𝗜𝗚𝗛𝗧𝗘𝗗 𝗢𝗩𝗚𝗠 (𝗘𝗠𝗣𝗧𝗬 𝗣𝗥𝗘𝗚𝗡𝗔𝗡𝗖𝗬) " 𝗟𝗶𝗞𝗲 & 𝗙𝗌𝗹𝗹𝗌𝘄 Kwata Style Medicine 🇚🇲⬇⬇⬇
🀰🏜👥𝑶𝒈𝒂 𝑎𝒓/𝑎𝒓𝒔 𝑺𝒎𝒂𝒓𝒕: Good morning doctor.

👩🏿‍⚕𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥 : Good morning. How for wuna??

🀰🏜👥𝑶𝒈𝒂 𝑎𝒓/𝑎𝒓𝒔 𝑺𝒎𝒂𝒓𝒕: We dey fine doctor.

👩🏿‍⚕𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥 : okay, nice!

🀰🏜👥𝑶𝒈𝒂 𝑎𝒓/𝑎𝒓𝒔 𝑺𝒎𝒂𝒓𝒕: Doctor I nova see my period for 2 months now, a bi do pregnancy test, e comot positive but for the past 2 days now, ma under belle bi di bite then this morning, I see small blood for my pant.

👩🏿‍⚕𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥 : Okay madam, wuna go do me Ultrasound (Echography) make we see

🀰🏜👥𝑶𝒈𝒂 𝑎𝒓/𝑎𝒓𝒔 𝑺𝒎𝒂𝒓𝒕: [walks in few minutes later with results). Doctor we don come back.

👩🏿‍⚕𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥 : Hmmmmm. Sorry madam, your result di show say you get miscarriage.

🀰🏜👥𝑶𝒈𝒂 𝑎𝒓/𝑎𝒓𝒔 𝑺𝒎𝒂𝒓𝒕: Miscarriage how doctor. I nor understand. I just see na small blood for my pants this morning o!!

👩🏿‍⚕𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥 : I understand you madam, sorry. The results di actually show say you get weti we di callam for big book say 𝗕𝗟𝗜𝗚𝗛𝗧𝗘𝗗 𝗢𝗩𝗚𝗠.

𝗧𝗵𝗶𝘀 𝗞𝗶𝗻𝗱 𝗯𝗲𝗹𝗹𝗲, 𝘁𝗵𝗲 𝘀𝗮𝗰/𝗜𝗹𝗮𝗰𝗲𝗻𝘁𝗮 𝗌𝗿 𝗿𝗮𝗜𝗲𝗻 𝘄𝗲𝗵 𝗜𝗶𝗞𝗶𝗻 𝗱𝗶 𝗎𝗿𝗌𝘄 𝗶𝗻𝘀𝗶𝗱𝗲 𝗱𝗶 𝗳𝗌𝗿𝗺 𝗳𝗶𝗻𝗲, 𝗯𝘂𝘁 𝗜𝗶𝗞𝗶𝗻 𝗱𝗶 𝗳𝗮𝗶𝗹 𝗳𝗌𝗿 𝗎𝗿𝗌𝘄 𝗶𝗻𝘀𝗶𝗱𝗲. 𝗜𝗻 𝘀𝗵𝗌𝗿𝘁, 𝗡𝗮 𝗯𝗲𝗹𝗹𝗲 𝘄𝗶𝘁𝗵 𝗻𝗌 𝗜𝗶𝗞𝗶𝗻 𝗶𝗻𝘀𝗶𝗱𝗲 𝘆𝗌𝘂𝗿 𝘄𝗌𝗺𝗯

🗣𝑶𝒈𝒂 𝑎𝒓 𝑺𝒎𝒂𝒓𝒕: Ah! doctor, this one na which kind one too nor? Weti di cause-am? Doctor na ma woman e first belle this oo.

👩🏿‍⚕𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥 : No specific thing di cause-am but mostly na some problem weh we di callam say genetic and chromosomal abnormalities. Most of this kind belle, you nodi even notice-am, e di pass with the woman e me**es but some di go on for develop and give symptoms for belle like the case for ya madam.

🀰🏜𝑶𝒈𝒂 𝑎𝒓𝒔 𝑺𝒎𝒂𝒓𝒕: [crying] Doctor weti are go do now? A go fit for born again?

👩🏿‍⚕𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥: Yes! you go fit born, e nodi affect your chance for born again. The fact say this belle end so no means say any increase chance dey for the next belle for be the same.
🟠🔞 Blighted o**m na just nature e way for deal away with any belle weh the pikin go get plenty problem weh no fit live normal life.

🟠🔞Now so, na for clean your womb and help move any remaining tissue them inside. We fit wait make your body movam he one.

🟠🔞Means say this blood weh you see go increase as days them di pass, we fit give you mesin weh go help force all remaining thing for comot aswell as we fit use some instrument them for remove the tissues.

🀰🏜👥𝑶𝒈𝒂 𝑎𝒓/𝑎𝒓𝒔 𝑺𝒎𝒂𝒓𝒕: Okay Doctor, do the one weh fine pass. Doctor abeg how long e fit stay before e take in again???

👩🏿‍⚕𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥 after one to two regular me**es. Meaning stay till you see your me**es for two months straight then you fit take in. wuna ashia, take heart. It is well.

🀰🏜👥𝑶𝒈𝒂 𝑎𝒓/𝑎𝒓𝒔 𝑺𝒎𝒂𝒓𝒕: Thank you doctor

👩🏿‍⚕𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥: You are welcome.

Writer : DOCTOR Tete Yvonne Holistic MD

𝗢𝗻 𝗧𝗵𝗶𝘀 𝗘𝗜𝗶𝘀𝗌𝗱𝗲 𝟲𝟲" 𝗧𝗛𝗘 𝗣𝗥𝗘𝗚𝗡𝗔𝗡𝗧 𝗩𝗜𝗥𝗚𝗜𝗡  "  𝗟𝗶𝗞𝗲 & 𝗙𝗌𝗹𝗹𝗌𝘄 Kwata Style Medicine  🇚🇲⬇⬇⬇🀰🏜☪🕌𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗔𝗶𝗰𝗵𝗮 𝗊𝗺𝗮𝗿𝘁:  Sala...
17/03/2024

𝗢𝗻 𝗧𝗵𝗶𝘀 𝗘𝗜𝗶𝘀𝗌𝗱𝗲 𝟲𝟲" 𝗧𝗛𝗘 𝗣𝗥𝗘𝗚𝗡𝗔𝗡𝗧 𝗩𝗜𝗥𝗚𝗜𝗡 " 𝗟𝗶𝗞𝗲 & 𝗙𝗌𝗹𝗹𝗌𝘄 Kwata Style Medicine 🇚🇲⬇⬇⬇
🀰🏜☪🕌𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗔𝗶𝗰𝗵𝗮 𝗊𝗺𝗮𝗿𝘁: Salam Alaikum!!! doctor.

👩🏿‍⚕𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥 :: Good morning madam. How you sleep ?

🀰🏜☪🕌𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗔𝗶𝗰𝗵𝗮 𝗊𝗺𝗮𝗿𝘁: I sleep fine doctor. But I really get something weh di worry me.

👩🏿‍⚕𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥 : Okay madam
 weti di worry you?

🀰🏜☪🕌𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗔𝗶𝗰𝗵𝗮 𝗊𝗺𝗮𝗿𝘁 : This belle so, a nodi still understand how I carry-am oh!! . Sotey e di want bring problem between me and my husband.

👩🏿‍⚕𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥 : I nor understand you madam, weti you mean?

🀰🏜☪🕌𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗔𝗶𝗰𝗵𝗮 𝗊𝗺𝗮𝗿𝘁 : Wah-lie

Doctor!! , since weh me and my husband married, we nova meet, the first day weh e bi try for put e manhood inside my private, I be di over fear plenty.... sotey he decide for leavam nor continue
🀰🏜Na after that weh I discoveram say I dey with belle and I married my husband as virgin.

🀰🏜If nobi na say, we bi muslim them, I sure say big problem for don dey between me and my husband... WWah-lie!!

👩🏿‍⚕𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥 : : Oh, I understand now. Wuside ya husand dey??

🀰🏜☪🕌𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗔𝗶𝗰𝗵𝗮 𝗊𝗺𝗮𝗿𝘁: E dey outside. I call he make he come???

👩🏿‍⚕𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥 : Yes madam.! Call he!

-Oga!! , your madam don explain some situation for me, na why that I call you so that when a di answer he, you too go di hear fine fine.

👳🏟‍♀𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿. 𝗊𝗺𝗮𝗿𝘁 : Okay Doctor!!! .

👩🏿‍⚕𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥 : One thing na say E be very possible for woman for carry belle even when your manhood nova enter e own private .

☪𝗊𝗲𝗲! 𝗔𝘀 𝗹𝗌𝗻𝗎 𝗮𝘀 𝘆𝗮 𝗌𝘄𝗻 𝗺𝗮𝗻𝗵𝗌𝗌𝗱 𝗱𝗲𝘆 𝗮𝗿𝗌𝘂𝗻𝗱 𝘆𝗮 𝘄𝗌𝗺𝗮𝗻 𝗵𝗲 𝗌𝘄𝗻 𝗜𝗿𝗶𝘃𝗮𝘁𝗲 𝘀𝗌𝗺𝗲 𝘀𝗺𝗮𝗹𝗹 𝘄𝗮𝘁𝗲𝗿 𝘄𝗲𝗵 𝗲 𝗱𝗶 𝗰𝗌𝗺𝗌𝘁 𝗳𝗿𝗌𝗺 𝘆𝗮 𝗺𝗮𝗻𝗵𝗌𝗌𝗱 𝘄𝗵𝗲𝗻 𝘆𝗌𝘂 𝗱𝗲𝘆 𝗶𝗻 𝘁𝗵𝗲 𝗺𝗌𝗌𝗱 𝗯𝗲𝗳𝗌𝗿𝗲 𝘆𝗌𝘂 𝗳𝗶𝗻𝗮𝗹𝗹𝘆 𝗜𝘂𝘁 𝘆𝗮 𝗺𝗮𝗻𝗵𝗌𝗌𝗱 𝗶𝗻𝘀𝗶𝗱𝗲 𝘆𝗌𝘂𝗿 𝘄𝗌𝗺𝗮𝗻 𝗲 𝗜𝗿𝗶𝘃𝗮𝘁𝗲; 𝗳𝗶𝘁 𝘀𝘁𝗶𝗹𝗹 𝗎𝗶𝘃𝗲 𝘄𝗌𝗺𝗮𝗻 𝗯𝗲𝗹𝗹𝗲. 𝗧𝗵𝗮𝘁 𝘀𝗺𝗮𝗹𝗹 𝘄𝗮𝘁𝗲𝗿 𝗷𝘂𝘀𝘁 𝗻𝗲𝗲𝗱 𝗳𝗌𝗿 𝘁𝗌𝘂𝗰𝗵 𝘁𝗵𝗲 𝗮𝗿𝗲𝗮, 𝗲 𝗳𝗶𝘁 𝗰𝗮𝗿𝗿𝘆 𝗯𝗲𝗹𝗹𝗲.

☪That small water weh di comot before you meet woman or when you even think for meeting woman, them di callam for big grammar say 𝗣𝗥𝗘-𝗘𝗝𝗔𝗖𝗚𝗟𝗔𝗧𝗘 𝗳𝗹𝘂𝗶𝗱𝘀.

☪This water fit get s***m some time them and when this s***m them touch the entrance for ya woman e private, them go climb up waka sotey go meetup the egg inside ya woman e body if na the time weh e egg dey ready and then pikin go form.

☪One thing weh wuna need for understand na say belle nodi happen na only when man and woman meetup sotey the man e manhood enter inside the woman e private na why tthat woman fit carry belle through weti them callam say "𝗔𝗥𝗧𝗜𝗙𝗜𝗖𝗜𝗔𝗟 𝗜𝗡𝗊𝗘𝗠𝗜𝗡𝗔𝗧𝗜𝗢𝗡".

☪When manpikin e s***m and woman e egg meetup, na so belle di form. The style weh e take meet no be how belle di form.

👳🏟‍♀𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿. 𝗊𝗺𝗮𝗿𝘁: Okay doctor. I understand now. Even though I trust ma woman but the thing bi di worry me small.

👩🏿‍⚕𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥 : Make e no worry wuna, this, na the best explanation for how the belle come about.

👳🏟‍♀👳𝙊𝙜𝙖 𝙈𝙧/𝙈𝙧𝙚 𝙎𝙢𝙖𝙧𝙩: Thank you very much doctor. Alhamdulillah!!!!🕌☪

👩🏿‍⚕𝗞𝗪𝗔𝗧𝗔 𝗗𝗢𝗖𝗧𝗢𝗥: You are welcome

Writer : DOCTOR Tete Yvonne Holistic MD

𝗢𝗻 𝗧𝗵𝗶𝘀 𝗘𝗜𝗶𝘀𝗌𝗱𝗲 𝟲𝟱" 𝗚𝗔𝗊𝗧𝗥𝗜𝗖 𝗙𝗢𝗥 𝗣𝗜𝗞𝗜𝗡  "  𝗟𝗶𝗞𝗲 & 𝗙𝗌𝗹𝗹𝗌𝘄 @ Kwata Style Medicine 🇚🇲⬇⬇⬇🙅🏿‍♀𝐎𝐠𝐚 𝐌𝐫𝐬. 𝐒𝐊𝐚𝐫𝐭: Good morning...
03/03/2024

𝗢𝗻 𝗧𝗵𝗶𝘀 𝗘𝗜𝗶𝘀𝗌𝗱𝗲 𝟲𝟱" 𝗚𝗔𝗊𝗧𝗥𝗜𝗖 𝗙𝗢𝗥 𝗣𝗜𝗞𝗜𝗡 " 𝗟𝗶𝗞𝗲 & 𝗙𝗌𝗹𝗹𝗌𝘄 @ Kwata Style Medicine 🇚🇲⬇⬇⬇
🙅🏿‍♀𝐎𝐠𝐚 𝐌𝐫𝐬. 𝐒𝐊𝐚𝐫𝐭: Good morning doctor.

👩🏿‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍 : Good morning Madam.. welcome .. weti bring you and pikin

🙅🏿‍♀𝐎𝐠𝐚 𝐌𝐫𝐬. 𝐒𝐊𝐚𝐫𝐭: Doctor we be dey here yesterday so the pikin nobi fit give s**t for lab but the results don ready now.

👩🏿‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍: Okay madam, give me.
Madam, the result di show say your pikin get “𝗚𝗔𝗊𝗧𝗥𝗜𝗧𝗜𝗊” (𝗚𝗮𝘀𝘁𝗿𝗶𝗰)

🙅🏿‍♀𝐎𝐠𝐚 𝐌𝐫𝐬. 𝐒𝐊𝐚𝐫𝐭: Doctor?? (open eyes surprisingly). Gastric for small pikin so? Nobi gastric di hold na only big man doctor?

👩🏿‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍: No madam, any person fit get gastritis and plenty thing them dey weh fit makam person get high chance for get gastric For your pikin e case, some germ (bacteria) weh we di callam for big book say 𝗛𝗲𝗹𝗶𝗰𝗌𝗯𝗮𝗰𝘁𝗲𝗿 𝗣𝘆𝗹𝗌𝗿𝗶 show positive.

🊠This germ when e enter your body, e dey attack your stomach then makam your stomach di produce plenty acid weh go start chop the walls them then you get the symptoms for gastritis.

🙅🏿‍♀𝐎𝐠𝐚 𝐌𝐫𝐬. 𝐒𝐊𝐚𝐫𝐭: [nodding the head] Okaaaa doctor. But na for wuside this kind germ di comot for small pikin

👩🏿‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍: Man fit get the bacteria through plenty means like if you happen for chop dirty chop weh e dey contaminated with s**t for person weh get the germ, water or even kitchen utensils, you fit also gettam from person to person through kissing.

🙅🏿‍♀𝐎𝐠𝐚 𝐌𝐫𝐬. 𝐒𝐊𝐚𝐫𝐭: Na so e dey doctor???

👩🏿‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍: Yes madam. Apart from this germ, plenty other things them dey weh fit increase person e chance for get gastritis like when you get 𝗯𝗮𝗱 𝗲𝗮𝘁𝗶𝗻𝗎 𝗵𝗮𝗯𝗶𝘁𝘀, 𝘆𝗌𝘂 𝗱𝗶 𝗰𝗵𝗌𝗜 𝗌𝘃𝗲𝗿 𝘀𝗜𝗶𝗰𝘆 𝗰𝗵𝗌𝗜, 𝘆𝗌𝘂 𝗱𝗶 𝗰𝗵𝗌𝗜 𝗹𝗮𝘁𝗲 𝗳𝗌𝗿 𝗻𝗶𝗎𝗵𝘁 𝗮𝗻𝗱 𝗱𝗶 𝘀𝗹𝗲𝗲𝗜 𝗶𝗺𝗺𝗲𝗱𝗶𝗮𝘁𝗲𝗹𝘆 𝗮𝗳𝘁𝗲𝗿 𝘆𝗌𝘂 𝗳𝗶𝗻𝗶𝘀𝗵 𝗰𝗵𝗌𝗜, 𝘆𝗌𝘂 𝗱𝗲𝘆 𝗌𝘃𝗲𝗿 𝘀𝘁𝗿𝗲𝘀𝘀, 𝘆𝗌𝘂 𝗱𝗶 𝗱𝗿𝗶𝗻𝗞 𝗜𝗹𝗲𝗻𝘁𝘆 𝗯𝗲𝗲𝗿 𝗮𝗻𝗱 𝘀𝗺𝗌𝗞𝗲 𝗲𝘁𝗰....

🊠So now so, we go give pikin treatment and then e go find say make we do all man for ya house e own test because nobi all man di get that germ then get symptoms.

🊠𝗊𝗌𝗺𝗲 𝗜𝗲𝗌𝗜𝗹𝗲 𝗱𝗶 𝘄𝗮𝗻𝘁 𝘀𝘁𝗮𝗿𝘁 𝗎𝗲𝘁 𝘀𝘆𝗺𝗜𝘁𝗌𝗺𝘀 𝘄𝗵𝗲𝗻 𝘁𝗵𝗲𝗺 𝗱𝗌𝗻 𝗮𝗹𝗿𝗲𝗮𝗱𝘆 𝗎𝗲𝘁 𝘀𝗌𝗺𝗲 𝗯𝗶𝗎 𝘄𝗌𝘂𝗻𝗱 𝗶𝗻𝘀𝗶𝗱𝗲 𝘁𝗵𝗲𝗶𝗿 𝗯𝗲𝗹𝗹𝗲 𝘄𝗲𝗵 𝗱𝗶 𝗯𝗹𝗲𝗲𝗱 𝗮𝗻𝗱 𝘁𝗵𝗲 𝗜𝗲𝗿𝘀𝗌𝗻 𝗎𝗌 𝗱𝗶 𝘀𝗵𝗶𝘁 𝗯𝗹𝗌𝗌𝗱. 𝗊𝗌 𝗲 𝗳𝗶𝗻𝗲 𝘀𝗮𝘆 𝗺𝗮𝗞𝗲 𝘄𝗲 𝘁𝗲𝘀𝘁 𝗮𝗹𝗹 𝗺𝗮𝗻 𝗳𝗌𝗿 𝘆𝗮 𝗵𝗌𝘂𝘀𝗲 𝗲𝘀𝗜𝗲𝗰𝗶𝗮𝗹𝗹𝘆 𝗮𝘀 𝘆𝗌𝘂 𝗱𝗌𝗻 𝘂𝗻𝗱𝗲𝗿𝘀𝘁𝗮𝗻𝗱 𝗵𝗌𝘄 𝗜𝗲𝗿𝘀𝗌𝗻 𝗳𝗶𝘁 𝗎𝗲𝘁 𝘁𝗵𝗲 𝗎𝗲𝗿𝗺.

🙅🏿‍♀𝐎𝐠𝐚 𝐌𝐫𝐬. 𝐒𝐊𝐚𝐫𝐭: Okay Doctor, a go come. A go bring the other pikin them and my man make we do the test. Thank you very much

👩🏿‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍. You dey welcome madam

Writer: DOCTOR Tete Yvonne 🩺
Holistic MD 🇚🇲

𝗢𝗻 𝗧𝗵𝗶𝘀 𝗘𝗜𝗶𝘀𝗌𝗱𝗲 𝟲𝟰 " 𝗊𝗠𝗘𝗟𝗟𝗬 𝗠𝗢𝗚𝗧𝗛 "  𝗟𝗶𝗞𝗲 & 𝗙𝗌𝗹𝗹𝗌𝘄 @ Kwatastylemedicine 🇚🇲⬇⬇⬇🙎🏿‍♀𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧: Good morning doctor...
24/12/2023

𝗢𝗻 𝗧𝗵𝗶𝘀 𝗘𝗜𝗶𝘀𝗌𝗱𝗲 𝟲𝟰 " 𝗊𝗠𝗘𝗟𝗟𝗬 𝗠𝗢𝗚𝗧𝗛 " 𝗟𝗶𝗞𝗲 & 𝗙𝗌𝗹𝗹𝗌𝘄 @ Kwatastylemedicine 🇚🇲⬇⬇⬇
🙎🏿‍♀𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧: Good morning doctor.

🧑🏿‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍: Good morning madam. How for you?

🙎🏿‍♀𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧: I dey fine o doctor. Actually, a nodi sick, a just want ask something concerning my guy.

🧑🏿‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍: Okay madam, go ahead

🙎🏿‍♀𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧: Thank you. Doctor, my guy e mouth di smell very badly sotey e di makam a di try for avoid him.

🙊A no even want make he come near me talk less for we for kiss. Now so, a want know weti fit be the possible problem so that a go fit know how for tell him because a no know how e go takam.

🧑🏿‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍: Wuna don dey together for how long?

🙎🏿‍♀𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧: 3 years now!!

🧑🏿‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍 : 3 years na plenty time nor, you get for don know how you fit tell he sensitive things them like this one. Before wuna start date, e mouth be di smell?

🙎🏿‍♀𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧: No doctor. I know how I fit tell he oh, but a no just know how e go takam. I actually come consult na my eye, then e come for ma head say make a see doctor talk about this thing weh di worry me.

🧑🏿‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍 : You do fine madam. 𝗠𝗢𝗚𝗧𝗛 𝗢𝗗𝗢𝗚𝗥 (𝗛𝗔𝗟𝗜𝗧𝗢𝗊𝗜𝗊) get plenty thing them weh fit cause-am like:

👄Some kind chop them weh get strong scent like garlic, onion.

👄Poor oral hygiene, when you nodi brush your mouth regularly and properly.

👄When you get some bacteria for your tongue weh di cause odour.

👄Some disease for your gums weh them di callam Periodontal disease

👄Smoking/ To***co products 🚬

👄Dry mouth, when your mouth nodi make plenty saliva

👄E fit also be na indication for some sick inside your skin like Diabetes, infection for your nose, lungs, stomach, liver, kidney, chronic sinusitis or even some sick weh them di callam say 𝗔𝗖𝗜𝗗 𝗥𝗲𝗳𝗹𝘂𝘅 𝗮𝗻𝗱 𝗖𝗛𝗥𝗢𝗡𝗜𝗖 𝗚𝗔𝗊𝗧𝗥𝗜𝗧𝗜𝗊 (𝗎𝗮𝘀𝘁𝗿𝗶𝗰)

👄The truth na say, you need for bring your guy for hospital make we check weti be the exact problem because the solution for mouth odour na for first know weti di causam. When we know weti be the cause, we go then know which treatment for give him.

🙎🏿‍♀𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧: okay, thank you doctor. A don notice-am say, e get some mouth wash spray weh e just pay-am.

🧑🏿‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍 : like I talk, we need for know the exact cause before we fit treat-am because nobi na only for di use mouth wash.

⚕E fit just be na poor oral hygiene weh e go need for adjust. Normally, you suppose brush your mouth plus your tongue very well.

⚕Most people nodi take time for brush their tongue. You suppose change your toothbrush regularly atleast every 3-4months, and then e dey advisable for use toothpaste weh contain 𝗙𝗟𝗚𝗢𝗥𝗜𝗗𝗘 like 𝗰𝗌𝗹𝗎𝗮𝘁𝗲, 𝗰𝗹𝗌𝘀𝗲-𝘂𝗜 𝗲𝘁𝗰.

⚕ If e di do all these things, then na more reason weh e get for come hospital.

🙎🏿‍♀𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧: Thank you plenty doctor. A go find way bring he.

🧑🏿‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍: Okay madam, a go di wait wuna.

WRITER: DOCTOR Tete Yvonne 🩺

𝗢𝗻 𝗧𝗵𝗶𝘀 𝗘𝗜𝗶𝘀𝗌𝗱𝗲 𝟲𝟯 " ( 𝗔 𝗧𝗥𝗚𝗘 𝗥𝗔𝗣𝗘 𝗊𝗧𝗢𝗥𝗬) "  𝗟𝗶𝗞𝗲 & 𝗙𝗌𝗹𝗹𝗌𝘄@Kwatastylemedicine 🇚🇲🀊🏟‍♀𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧: [Crying] this ma pi...
03/12/2023

𝗢𝗻 𝗧𝗵𝗶𝘀 𝗘𝗜𝗶𝘀𝗌𝗱𝗲 𝟲𝟯 " ( 𝗔 𝗧𝗥𝗚𝗘 𝗥𝗔𝗣𝗘 𝗊𝗧𝗢𝗥𝗬) " 𝗟𝗶𝗞𝗲 & 𝗙𝗌𝗹𝗹𝗌𝘄@Kwatastylemedicine 🇚🇲
🀊🏟‍♀𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧: [Crying] this ma pikin dey with belle oh!(pregnant)
.

👚🏟‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍: Calm down madam, weti happen??

🀊🏟‍♀𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧: About 2 months ago, them r**e this ma pikin. Then last week, a notice say e di so so weak weak then di over sleep. I want ask weda e don see e me**es , e say NO! .

🀊🏟‍♀Na for dey weh a start investigate sotey we run go for some small meresin store for corner house, them do the test, e comot positive.

🀊🏟‍♀Doctor I no go fit this kind shame ooo! I go put my head and face for wuside.

🀊🏟‍♀ How I go take handle this kind shameful situation ?. I go go for wuside hide this shame!!. Doctor abeg help me !!

👚🏟‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍: Madam Abeg try for calm down!!! Time weh them r**e this your pikin, wuna be come hospital immediately????

🀊🏟‍♀𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧: NO doctor.

👚🏟‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍: Why na mami?. Wuna for come hospital immediately. By the way, you know the person weh e r**e your pikin?? Because the way you cry he dey like you know!

🀊🏟‍♀𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧: Hmmmmm doctor, na shame ooo doctor. This matter so nobi fine one. Nobi thing for di talkam outside.!

👚🏟‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍: Weti you mean??

🀊🏟‍♀𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧: The person weh do this thing na family person. Na why that you see me I di cry plenty so.

👚🏟‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍: Madam, who be the person?? E no change anything say the person na CRIMINAL because 𝗥𝗔𝗣𝗘 na 𝗕𝗜𝗚 𝗖𝗥𝗜𝗠𝗜𝗡𝗔𝗟 𝗔𝗖𝗧.

😒You di only cry about shame and side weh you go put your head for shame. You don think about weti this pikin fit di go through?

🀊🏟‍♀𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧: Hmmmmmm WEHH!! Papagot!

👚🏟‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍: Weti be your pikin e age?

🀊🏟‍♀𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧: 14 years doctor

👚🏟‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍: Your 1st priority na this your pikin not how for hide the person weh do the act.

😒Just this particular thing so fit destroy this pikin e life forever!!!!

🀊🏟‍♀𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧: Doctor na why that I come, so that them fit move the belle because I know say the belle go di only remind the pikin for the situation.

👚🏟‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍: Madam, you sure say this decision na for the best interest for this your pikin or na for hide the person weh do the act? You know say this pikin fit develop complication during the abortion process weh e fit bleed sotey die or even for future e no fit fit for born again? You think all this things before you come down with this decision so? By the way? Who be that criminal?

🀊🏟‍♀𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧: Doctor, abeg make we no go for that side abeg you.

👚🏟‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍: No madam, we don already enter the topic. We must discuss all thing. If not, we no go continue anything.

🀊🏟‍♀𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧: Hmmmmmm. Na he papa?

👚🏟‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍: E true born papa?? Na your real pikin too this??

🀊🏟‍♀𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧: Yes doctor, na my first pikin. No, na man weh a marret he. A marret he weh this pikin nova even reach 1 year so, e grow know na this man as e papa.

👚🏟‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍: Oh, I see. So you di protect your criminal husband over your pikin. Madam, this na week for fight against Gender Base Violence and na cases like this ones weh we di try for fight against for our society.

🎗You need for unite with all other authorities weh di put power for end this bad thing against women rather than for di hide your massa. You massa na criminal and need for be arrested.

🀊🏟‍♀𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧: Doctor


👚🏟‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍: Madam wait first. A di first over vex with you say you no bring this pikin for hospital immediately. This pikin need medical and psychological attention.

😒 The more you di hide your massa, you di instead punish the victim ( this pikin) then protect the perpetrator(your massa) weh e no get for dey so.

🀊🏟‍♀𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧: So if a for come hospital early, e no for get belle?

👚🏟‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍: Possible. Normally, when them r**e you, you must make sure you report for hospital immediately within 24 hours because tests them dey weh we get for doam and thing them dey weh we go do for prevent situations like this within 24 hours. You di fear only belle, what if this pikin don carry some chronic infection like HIV, Hepatitis B , GONORRHEA, SYPHILIS OR CHLAMYDIA ?
YOU know your massa e HIV status???

🀊🏟‍♀𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧: I no sure doctor.

👚🏟‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍: You see nor madam. Within 72hours after them r**e person, e need for do 3 things them.

𝟭) 𝗣𝗿𝗶𝗌𝗿𝗶𝘁𝗶𝗲𝘀 𝘀𝗮𝗳𝗲𝘁𝘆 𝗳𝗶𝗿𝘀𝘁:
𝗧𝗵𝗲 𝘃𝗶𝗰𝘁𝗶𝗺 𝗺𝘂𝘀𝘁 𝗿𝘂𝗻 𝗮𝘄𝗮𝘆 𝗳𝗿𝗌𝗺 𝘁𝗵𝗲 𝗜𝗲𝗿𝗜𝗲𝘁𝗿𝗮𝘁𝗌𝗿 𝗌𝗿 𝗲𝘃𝗲𝗻 𝘁𝗵𝗲 𝗜𝗹𝗮𝗰𝗲𝘀 𝘄𝗵𝗲𝗿𝗲 𝗲 𝗱𝗲𝘆 𝗜𝗌𝘀𝘀𝗶𝗯𝗹𝗲 𝗳𝗌𝗿 𝘀𝗲𝗲 𝘁𝗵𝗲 𝗜𝗲𝗿𝗜𝗲𝘁𝗿𝗮𝘁𝗌𝗿. 𝗧𝗵𝗲𝗻 𝗻𝗲𝘅𝘁 𝘁𝗵𝗶𝗻𝗎 𝗻𝗮 𝗳𝗌𝗿 𝘀𝗲𝗲𝗞 𝗺𝗲𝗱𝗶𝗰𝗮𝗹 𝘀𝘂𝗜𝗜𝗌𝗿𝘁 𝗶𝗺𝗺𝗲𝗱𝗶𝗮𝘁𝗲𝗹𝘆. 𝗪𝗵𝗲𝗻 𝘁𝗵𝗲 𝗜𝗲𝗿𝘀𝗌𝗻 𝗰𝗌𝗺𝗲 𝗵𝗌𝘀𝗜𝗶𝘁𝗮𝗹, 𝘁𝗵𝗲𝗺 𝗰𝗵𝗲𝗰𝗞 𝗺𝗮𝗞𝗲 𝗲 𝘁𝗲𝘀𝘁 𝘁𝗵𝗲𝗺 𝗳𝗌𝗿 𝗶𝗻𝗳𝗲𝗰𝘁𝗶𝗌𝗻 𝘄𝗲𝗵 𝘁𝗵𝗲𝗺 𝗳𝗶𝘁 𝘁𝗿𝗮𝗻𝘀𝗳𝗲𝗿𝗮𝗺 𝘁𝗵𝗿𝗌𝘂𝗎𝗵 𝘀𝗲𝘅 𝗮𝗻𝗱 𝗎𝗶𝘃𝗲 𝗮𝗻𝘆 𝗻𝗲𝗰𝗲𝘀𝘀𝗮𝗿𝘆 𝗺𝗲𝘀𝗶𝗻 𝗳𝗌𝗿 𝗜𝗿𝗲𝘃𝗲𝗻𝘁𝗮𝗺, 𝘁𝗲𝘀𝘁 𝗲 𝗳𝗌𝗿 𝗯𝗲𝗹𝗹𝗲 𝗮𝗻𝗱 𝗶𝗳 𝗲 𝘀𝗵𝗌𝘄 𝘀𝗮𝘆 𝗲 𝗳𝗶𝘁 𝗎𝗲𝘁 𝗯𝗲𝗹𝗹𝗲, 𝗎𝗶𝘃𝗲 𝘁𝗵𝗲 𝘃𝗶𝗰𝘁𝗶𝗺 𝗺𝗲𝗿𝗲𝘀𝗶𝗻 𝗳𝗌𝗿 𝗜𝗿𝗲𝘃𝗲𝗻𝘁𝗮𝗯𝗹𝗲.

𝟮) 𝗚𝗮𝘁𝗵𝗲𝗿 𝗘𝘃𝗶𝗱𝗲𝗻𝗰𝗲:
𝗧𝗵𝗲𝗺 𝗎𝗌 𝘀𝘁𝗮𝗿𝘁 𝗶𝗻𝘃𝗲𝘀𝘁𝗶𝗎𝗮𝘁𝗶𝗌𝗻 𝘀𝗌 𝘁𝗵𝗮𝘁 𝘁𝗵𝗲𝗺 𝗳𝗶𝘁 𝗎𝗮𝘁𝗵𝗲𝗿 𝗲𝘃𝗶𝗱𝗲𝗻𝗰𝗲 𝗳𝗌𝗿 𝗯𝗿𝗶𝗻𝗎 𝗷𝘂𝘀𝘁𝗶𝗰𝗲 𝘁𝗌 𝘁𝗵𝗲 𝘃𝗶𝗰𝘁𝗶𝗺. 𝗊𝗌 𝗲 𝗱𝗲𝘆 𝘃𝗲𝗿𝘆 𝗶𝗺𝗜𝗌𝗿𝘁𝗮𝗻𝘁 𝘀𝗮𝘆 𝗶𝗺𝗺𝗲𝗱𝗶𝗮𝘁𝗲𝗹𝘆 𝗮𝗳𝘁𝗲𝗿 𝗿𝗮𝗜𝗲, 𝗺𝗮𝗞𝗲 𝘁𝗵𝗲 𝘃𝗶𝗰𝘁𝗶𝗺 𝗻𝗌 𝘄𝗮𝘀𝗵, 𝗰𝗵𝗮𝗻𝗎𝗲 𝗰𝗹𝗌𝘁𝗵𝗲𝘀 𝗌𝗿 𝗲𝘃𝗲𝗻 𝗜𝗶𝘀𝘀. 𝗠𝗮𝗞𝗲 𝘁𝗵𝗲 𝗜𝗲𝗿𝘀𝗌𝗻 𝗿𝗲𝗜𝗌𝗿𝘁 𝗲 𝘀𝗲𝗹𝗳 𝗷𝘂𝘀𝘁 𝘁𝗵𝗲 𝘄𝗮𝘆 𝗲 𝗯𝗲 𝗱𝗲𝘆 𝗮𝗳𝘁𝗲𝗿 𝘁𝗵𝗲 𝗮𝗰𝘁 𝗯𝗲𝗰𝗮𝘂𝘀𝗲 𝗮𝗹𝗹 𝘁𝗶𝗻𝗎 𝘄𝗲𝗵 𝘁𝗵𝗲𝗺 𝗎𝗌 𝘀𝗲𝗲𝘆𝗮𝗺 𝗳𝗌𝗿 𝘁𝗵𝗲 𝗜𝗲𝗿𝘀𝗌𝗻 𝗲 𝗯𝗌𝗱𝘆 𝗎𝗌 𝗯𝗲 𝘂𝘀𝗲 𝗮𝘀 𝗲𝘃𝗶𝗱𝗲𝗻𝗰𝗲.

𝟯) 𝗊𝘂𝗜𝗜𝗌𝗿𝘁 :
𝗥𝗮𝗜𝗲 𝘃𝗶𝗰𝘁𝗶𝗺 𝘁𝗵𝗲𝗺 𝗻𝗲𝗲𝗱 𝗜𝗹𝗲𝗻𝘁𝘆 𝗜𝘀𝘆𝗰𝗵𝗌𝗹𝗌𝗎𝗶𝗰𝗮𝗹 𝘀𝘂𝗜𝗜𝗌𝗿𝘁 𝘀𝗌 𝘁𝗵𝗮𝘁 𝘁𝗵𝗲𝗺 𝗳𝗶𝘁 𝗵𝗲𝗮𝗹 𝗳𝗿𝗌𝗺 𝘁𝗵𝗲 𝘁𝗿𝗮𝘂𝗺𝗮 𝗜𝗿𝗌𝗜𝗲𝗿𝗹𝘆 𝗯𝗲𝗰𝗮𝘂𝘀𝗲 𝗶𝗳 𝘁𝗵𝗲𝗺 𝗻𝗌 𝗵𝗮𝗻𝗱𝗹𝗲 𝘁𝗵𝗶𝘀 𝗮𝘀𝗜𝗲𝗰𝘁 𝘀𝗲𝗿𝗶𝗌𝘂𝘀𝗹𝘆, 𝘁𝗵𝗲 𝘃𝗶𝗰𝘁𝗶𝗺 𝗳𝗶𝘁 𝗲𝗻𝗱 𝘂𝗜 𝗞𝗶𝗹𝗹 𝗵𝗲𝗿𝘀𝗲𝗹𝗳 𝗯𝗲𝗰𝗮𝘂𝘀𝗲 𝗜𝗲𝗌𝗜𝗹𝗲 𝗱𝗶 𝗿𝗲𝗮𝗰𝘁 𝗱𝗶𝗳𝗳𝗲𝗿𝗲𝗻𝘁𝗹𝘆 𝗳𝗿𝗌𝗺 𝘁𝗿𝗮𝘂𝗺𝗮.

𝟰)𝗙𝗥𝗘𝗘 𝗟𝗲𝗎𝗮𝗹 𝗛𝗲𝗹𝗜 :
𝗶𝗳 𝘆𝗌𝘂 𝗻𝗌𝗿 𝗎𝗲𝘁 𝗺𝗌𝗻𝗲𝘆 𝗳𝗌𝗿 𝗳𝗶𝗻𝗱 𝗹𝗮𝘄𝘆𝗲𝗿 𝘀𝗌𝗺𝗲 𝗻𝘂𝗺𝗯𝗲𝗿𝘀 𝘁𝗵𝗲𝗺 𝗱𝗲𝘆 𝘄𝗮𝘆 𝘆𝗌𝘂 𝗳𝗶𝘁 𝗰𝗮𝗹𝗹 𝘄𝗮𝘆 𝗵𝗲 𝗎𝗌 𝗵𝗲𝗹𝗜 𝗳𝗌𝗿 𝗲𝘅𝗮𝗺𝗜𝗹𝗲𝘀 𝗹𝗶𝗞𝗲 :

𝗙𝗜𝗗𝗔(𝗟𝗜𝗠𝗕𝗘) :𝟲𝟳𝟳𝟲𝟎𝟮𝟭𝟵𝟭, 𝟲𝟳𝟳𝟳𝟯𝟯𝟳𝟎𝟯
𝗛𝗚𝗠𝗔𝗡 𝗥𝗜𝗚𝗛𝗧(𝗕𝗚𝗘𝗔) 𝟲𝟵𝟳𝟯𝟎𝟱𝟵𝟯𝟮
𝗖𝗕𝗖𝗛𝗊(𝗧𝗜𝗞𝗢): 𝟲𝟳𝟮𝟵𝟵𝟰𝟱𝟱𝟎
𝗖𝗔𝗠 𝗛𝗘𝗟𝗣(𝗟𝗜𝗠𝗕𝗘): 𝟲𝟳𝟵𝟲𝟭𝟭𝟮𝟎𝟎

🀊🏟‍♀𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧: Thank you oo! Coz my massa na first big man and I nor first even know how for start say I want drag he for court.

👚🏟‍⚕𝙆𝙒𝘌𝙏𝘌 𝘿𝙊𝘟𝙏𝙊𝙍: Now so madam, i go take you, we go for our Gender Base Violence Unit so that we fit see how to start handle this situation.

🀊🏟‍♀𝗢𝗎𝗮 𝗠𝗿𝘀. 𝗊𝗠𝗔𝗥𝗧: Okay Doctor, thank you

Writer : DOCTOR Tete Yvonne
🇚🇲

Adresse

Limbe Camp
Limbe

Notifications

Soyez le premier à savoir et laissez-nous vous envoyer un courriel lorsque Kwata Style Medicine publie des nouvelles et des promotions. Votre adresse e-mail ne sera pas utilisée à d'autres fins, et vous pouvez vous désabonner à tout moment.

Contacter La Pratique

Envoyer un message à Kwata Style Medicine:

Partager