24/08/2021
Bros Efe: I treat typhoid last month and last 2 months.
Inshort, I don treat typhoid four good times this year. Time wen my mates take dey hustle, I take am dey treat sickness.
Now again, e don start.. My body dey hot, on and off, all my joint, muscle, everywhere dey pain me like say panel-beater handle me. My eyes dey turn me sotaay...if you shift make I faint, I fit really faint true true. Even my belle no be my own again.
Ah, TYPHOID no be better thing. Abi na my village people... 🤔
I don go hospital taya. I no go again abeg. Wetin sef, anytime the doctor send me go do MP WIDAL, Malaria and typhoid must come out. High one o. The level dey reach 160 or
320. Even HIV and Hepatitis sef… I don do all of them, but na only typhoid dem dey see.
Make I jus go buy that CIPROTAB drug for the pharmacy wey dey junction. I go dey ok las las.
**Bros Efe reaches pharmacy, pharmacist advises him to go do one more MP WIDAL at NEWFOUND LABS.
I no do abeg. Na today? I know wetin I get, so I no fit waste my money. Give me drugs make I dey comot.
**He buys his drugs. On his way he sees the 'NEW' lab and drops by, just to see what's happening there. Who knows…maybe he'd just do the test...and also advise them say the name no too make sense, because all old labs were once 🆕
▪️
▪️
▪️
Guess who's in my office! Bros Efe wants to do 'malaria and typhoid'!
Bros Efe: Nurse, I wan check malaria and typhoid before I start my drugs. I know say e dey for sure but my mind say make I just confirm am.
Me: I'm Scientist Eunice. Thanks for choosing NEWFOUND LABS.
Bros Efe: Ok..sorry..scientist.
Me: Welcome 🙂 You made a good choice to come here.
**I give him 2 containers.
Take… we need your urine and your stool for the test.
Bros Efe: Stool? Stool na wetin?
Me: We need your p**s and your s**t.
P**s inside this one. But first p**s small put for toilet before you let the p**s enter this can.
I wan get your cleanest p**s that's why. So, p**s for toilet, then p**s inside the container nearly full, then p**s the remaining one for toilet. OK?
As for the s**t, no s**t am direct for toilet, e get why.
Spread tissue cover your hand use am grab the s**t before e fall enter toilet. Then use your eyes check am well. If you see any part wey be like blood or catarrh, use this small spoon serve that part give us for this second container. Otherwise, just serve any part of the s**t wey you like.
Bros Efe: (Looks at me in bewilderment)... Madam scientist no vex o. P**s and s**t na better thing like this? No be blood una take dey check typhoid? WIDAL abi wetin be the name again?
Me: It depends...We fit take your blood too. You dey get fever at all?
Bros Efe: Yes, the fever dey come dey go.
Me: Okay. If your temperature begin rise, na that time we go take your blood for the test, make we fit see the typhoid wey we dey find. Na blood culture test we dey call am.
Bros Efe: Wow! Una dey try o! But me know say culture test dey waste time o. How I wan take hol bodi take wait for the result?
Me: Drink 1 pure water every 1 hour.
Eat apple for morning, eat cucumber for evening.
Jus dey watch yourself, dey take paracetamol. If e no dey better, call me. I fit give you another advice.
** Bros Efe leaves satisfied. I could sense he was brighter already! 😀 Returns his urine and stool samples an hour later and leaves again.
**We get to work…
▪️
▪️
▪️
Results are ready.
Shocker! His stool shows typhoid! What?? Salmonella, the black bacteria. Me sef I didn't predict this. Because it is my passion to prove that not everything is typhoid.
Well…it is what it is.
But guess what? The antibiogram shows that only good old Amoxicillin and Gentamycin are the best drugs for his case. Our guy's CIPROTAB was a waste of money and time.
*He shows up this evening for his results.
Bros Efe: How fa nah? I get typhoid?
Because as I dey like dis, I don get myself o. Be like say water and cucumber na final wiper for typhoid. I don well finish as I dey like this.
Me: The test show say you get typhoid. Congratulations.
Bros Efe: 🙄Ah…Why?
Me: Because now you know! Now we know too! We know say na typhoid wey dey resist drugs, including your ciprotab. You need to treat am with the right medication to protect yourself and your family. If you didn't take our stool test, how would you have known?
Bros Efe: Wow! So una dey do drug test for the sickness too. I like this one o. The other WIDAL test wey I been dey do no dey carry drugs o.
Una need to do seminar about this Malaria and Typhoid wahala. I go bring all my family and compound people for checkup o. If una need campaign manager, na my work be dat.
Me 😀😀Very soon. We will surely let you know when it's time.
**Bros Efe leaves happy and fulfilled…
Say NO to guesswork in healthcare‼️
It's not always typhoid‼️
Embrace quality testing✔️
Insist on the right tests before treatment✔️
.. Did you like this post? Feel free to Share it!
Like our page for more medical stories 👩🔬