05/06/2024
Country People!
How una dey? Hope all of una dey jolly for township!
For this March wey pass so, our campaign manager Dauda Onawola and the ambassador for Osun State Christian Okonkwo enter Ilesha go follow members of Ilesha Hunters Association talk. For the talk inside, the hunters gree say animals don reduce for forest. NO BE GOOD THING AT ALL! Imagine say we come dey show our pikin animals we come meet for this world inside paper because we kill them finish onto longathroat. That way no pure, na im make we continue dey yearn say make everybody allow wild animals rest! Make dem jus dey forest like that.
Make we remember say all the big disease them, na our longathroat bring them. Whether na Lassa Fever ooo, whether na Ebola ooo, COVID-19, Marburg fever, Mpox and so so. If we no dey chop bushmeat or enter forest dey cut tree anyhow, we for no dey see all these things.
For inside the photo, you go see person wey dey ask question, wetin e dey ask be say wetin dem fit dey do id dem stop dey hunt since na their own handiwork be that. Our campaign manager tell am say, you start dey keep chicken, goat, sheep, snail, rabbit, even fish for pond make you dey run the business. Small time, you go get plenty money from that one because your animals go dey multiply. But hunting no be like that. One day, you go enter forest no see animals again, how e go be? You sef reason am!
Oya join the better people, stop dey chop bushmeat!
Limbe Wildlife Centre Pro Wildlife e.V. Pandrillus WildAid WildAid Africa National Park Service Nigerian Veterinary Medical Association Nigeria Centre for Disease Control VETERINARY COUNCIL OF NIGERIA FmardPace Federal Ministry of Health Nigeria