03/08/2020
Sumtimes wen I hear when guys dey
talk say girls get fish brain, d tin dey make me laff.
U say girls get fish brain yet wen e don reach Christmas u go spend close To 50k for ur gf, common greetin card she nor go give u.
U say girls get fish brain, yet wen e don reach time for Valentine, u go give ur gf all d gifts wen dey dis world but she go give u only boxers & u will b happy.
For inside d 2 of una my brother who get fish brain, u nor just get fish brain but u also get cow sense.
Ok see Kelvin wen quarrel wit him
babe for my area d other day.......pple
cum dey ask d girl say "Blessing, now
wen u & Kelvin nor dey again, wentin
u go talk now say u achieve 4rm d
relationship".. ........
Naim d girl say "well, Kelvin saw me thru sch, he paid my mother's hospital bills wen she was ill, thru out d 4yrs i dated
him he gave me money for cloths, shoes, & even for my up keep, there was a time he even gave two of my younger 1's 20k each to enrol for their SSCE, Anyway I gained a lot sha".
So everybody cm turn to Kelvin, dem ask my guy "Bros, wat of u? Wetin u go talk now say u achieve 4rm d relationship for d past 4yrs?".
My pple, do u know say till 2day Kelvin neva still fit answer dat
question......& yet any small tin guys go dey say girls get fish brain.
I dey pity sum guys wen dey follow talk dat kind word, mayb na bcus say girls neva really get ur time.
If babe get ur time handle u eh.....oh
my brother!....dat money wen ur
senior brother give u make u take go
pay d doctor wen dey treat ur mama
for hospital, u go carry am give ur gf
make she take go do hair.
My guy, make u just dey pray make girl nor get ur time o.
Even those G-boys wen we dey talk
2day say dem too get brain......anytime dem touch money, na who dem dey spend d money on? Na still
d same women wen we dey talk say
get fish brain dey help dem chop d
money!
Ok if u think say lie, then carry biro &
paper calculate all d tins wen u don
achieve since u begin date ur
gf.......wen u don calculate am finish,
turn d paper, calculate tins wen ur gf
don achieve 4rm u.......wen u don do
all dis 1 finish, then ask ur sef......"Me
& my gf who get fish brain?"
If u fit tell urself d truth, u go agree
wit me say d only tin wen u don
achieve na s*x,, for d past 3yrs wen u dey date her.
& wetin she don achieve 4rm u na
shoe, bag, sch fees, accommodation
fee, handset, hair money, recharge
card, fast food, sanitary pad, eye
pencil, eye shadow, mary cay,
powder, underwear, lipstick,
transport fare, cloths, night gown,
perfume, body spray, tooth paste,
toothbrush..... .infact I don tire
to count......but oyibo go say "etc".
Abeg ooooo i come in Peace