
26/08/2022
Police for Katsina state don arrest 25 year old Najib Shehu wey dem say use pestle beat im step mother to death and wounjure im father after misunderstanding.
Tok tok pesin of Katsina Police Command Gambo Isah for statement yan say as a result of misunderstanding, Najib rush enter kitchen wia e grab pestle and begin hit im step mother, 60 year old Asiya Mohammed for head wey later result to her death.
Di suspect Najib no finish dia, as e use di same pestle to hit im father wey lead to am suffering several fractures.
Police say dem don seize di pestle and investigation into di case dey continue at dis time.