06/07/2023
Once upon a time for dis small village, e get one man him name na Okon. Okon, e dey always waka waka for street, dey form say e sharp. But one day, e eye come begin dey yama yama.
na so so wahala eye problem dey worry okon. Him eye bin dey red, dey scratch, dey pain dem like say pesin dey use sandpaper rub eye. Him carry p**s put for eye, for who side! Eyes come red more like tomato jos he come wear sunglasses like say na Hollywood him dey act. E be like say village people don jazz Okon eyes.
Okon go meet im friend, Emeka, and im tell am say, "Emeka, my eye don dey do me one kain. E dey scratch me like say I chop pepper!"
Emeka, wey be sharp man, tell am say, "Okon, no play with your eye oh! If you no take care of am, you go turn blind man for dis village." come dey go see eye doctor ooo. My hand no dey oo
Okon begin fear, so e go see im mama for advice. Mama Okon talk say, "My pikin, make you chop plenty carrots and green leafy vegetables. E go help your eye shine like sun."
Okon say, "Mama, na joke you dey joke? I no go chop veggies oh! I be correct Naija man, na Atama soup and fufu I sabi."
But Mama Okon no gree hear. She say, "Okon, if you no chop veggies, na kraw kraw go chop your eye finish!"
Okon fear small small, so e decide to go see Dr. Ada for the village clinic. Dr. Ada na ogbonge eye doctor wey sabi book.
As Okon reach Dr. Ada clinic, e say, "Doctor, abeg, my eye don dey worry me. Wetin I go do?"
Dr. Ada, wey be gentle lady, smile and reply, "Okon, e get one saying wey dem talk say 'na laughter be the best medicine.' Laughter dey reduce stress and fit help your eye too." Dr Ada come look him eye give am melecine, teach wetin in go do.
Okon begin laugh, "Ha ha ha! Doctor, you talk true oh! Laughter na correct remedy."
From that day ,Okon come dey take care of him eyes. Okon begin dey laugh e heart out. E go watch plenty comedy show for TV and go laugh with im friends every day. Im eye come begin shine like the moon for night.
Okon don learn lesson, say eye health no be play play matter. E no dey chop only Atama ok soup and fufu again, but e dey chop veggies too. Na so Okon eye begin shine like Oba palace for Naija.
So my people, make una take eye health serious. No dey dull, chop veggies, laugh well-well, and visit eye doctor sharp sharp. Na so una go see clearly like Okon.